Israeli tanks dey move enta inside Gaza City, Trump ready to address UN General Assembly

Date:

As world leaders including US President Donald Trump gada for di UN General Assembly, tanks and armoured vehicles wey belong to di Israeli don move enta Gaza City.

Israeli forces dey kontinu dia ground offensive to fully occupy Gaza City as witnesses report say tanks don enta into di city centre from di north and south.

Di locals say Israeli artillery shelling and attacks by quadcopter drones dey drive pipo comot from dia homes for Gaza City. Israel dey use armoured vehicles wey get explosives to blow up blocks of houses.

Meanwhile, as dis entrance into Gaza City and attacks dey go on, US President Trump dey prepare to address di 80th annual UN General Assembly wey dey happun for New York later today.

Trump also dey expected to meet leaders from di Middle East for separate meeting for di UN afta im address.

Part of wetin Trump dey expected to mention na di situation wey dey go on for Gaza and di Israeli attacks, including di recognition of Palestinian state by some kontris.

Several kontris don formally recognise Palestinian statehood ova di past two days as Israel dey kontinu dia assault on Gaza City.

France, wey dey co-host di event wit Saudi Arabia, don join list of kontris wey formally recognise Palestinian state afta similar announcements from di UK, Canada and Australia on Sunday.

Although, Trump no attend di pre-assembly conference for di two-state solution to di Israel-Gaza conflict, but im address today go touch on plenti tins.

Trump go still host di Israel Prime Minister Benjamin Netanyahu for 29 September 2025, but bifor dat e go do meetings wit officials from UAE, Qatar, Egypt, Jordan, Turkey, Indonesia and Pakistan to discuss di situation for Gaza on Tuesday afternoon.

Meanwhile, di US don criticised di move to recognise Palestinian state and di two-state solution dey no go help to end di conflict as Israeli Prime Minister Netanyahu tok say “Palestinian state no go dey”

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

Share post:

Subscribe

Popular

More like this
Related

Court approves three Labs for DNA tests to determine paternity of Mohbad’s son

The Ikorodu High Court in Lagos state has approved...

Russia threatens to use Nuclear bomb on Ukraine

Deputy Chairman of Russia’s Security Council, Dmitry Medvedev, has...

President Tinubu appoints Tunji Disu as acting Inspector-General of Police as Egbetokun resigns

President Bola Ahmed Tinubu, GCFR, has accepted the resignation...

FCT Council Polls record 14% Turnout Up from 9.4% in 2022 — INEC

The Independent National Electoral Commission (INEC) has announced that...